Jos school collapse: Saint Academy closed down by government, three days mourning declared afta building collapse kill 22 pipo - BBC News Pidgin (2024)

Jos school collapse: Saint Academy closed down by government, three days mourning declared afta building collapse kill 22 pipo - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, Getty Images

Plateau state government don declare three days mourning for lives wey lost for di Saint Academy School building collapse on Friday.

Di government order say make dem fly all flags for di state for half-mast during di three-day mourning wey start from Saturday 13 July to July 15 to honour victims of di school building collapse.

Plateau authorities tok inside one statement digned by di State Commissioner for Information, Musa Ashoms.

Govnor Caleb Mutfwang, wen e bin visit di school early on Saturday, bin tok sorry to families wey dey affected for di incident.

E ask citizens to strictly follow building codes and ethics so dem go fit prevent dat kind tragedy.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

“We offer our deepest sympathies and unwavering support to those wey dey affected during dis really difficult time”.

“We dey dedicated to provide di best possible medical care for those wey innjure and go conduct ogbonge investigation to sabi wetin cause di collapse,” e tok.

Muftwang also announce make dem immediately close Saint Academy School and e order full investigation into di collapse matter.

Earlier, Plateau State police command bin confam say at least 22 pipo die following di collapse of two-storey building wey dey house one school for Jos, Plateau State inside north-central Nigeria.

Plenti students wey reach 154 bin dey trapped under di building, according to di state police.

Di building of Saints Academy wey dey for Busa Buji for Jos North Local Government Area collapse during school hours wen class bin dey go on, on Friday morning.

Di school premises bin dey crowded on Friday. Parents bin full di premises as dem dey look for dia children.

Commissioner of Police for Plateau State, Emmanuel Adesina say 132 odas wey dem rescue dey receive treatment for hospital.

Many wey don see di deadi bodis of dia children dey in mourning. Rescue workers, volunteers and emergency officials rush to di scene and help rescue dose wey bin dey under di rubble.

Rescue workers bin use excavators to dig through di . destruction

Tori be say di school get more dan one thousand students. At di moment e neva clear wetin make di building collapse.

Many parents bin go hospitals for Jos metropolis to look for dia missing children.

Medics also call pipo to donate blood to support many wey dem rush go hospitals.

  • Na truck run into Banana Island building wey collapse - LASEMA
  • How dog help rescuers save man from South Africa collapsed building
  • Death toll from Lagos mosque collapse rise to three as one adult join teenage girls wey die

Jos school collapse: Saint Academy closed down by government, three days mourning declared afta building collapse kill 22 pipo - BBC News Pidgin (2)

Skip Facebook post

Allow Facebook content?

Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post

'I dey opposite di school wen I hear loud sound'

Meanwhile eyewitnesses for di area Samuel Akpan narrate to BBC Pidgin how di building collapse take happun.

Samuel wey be one of di eyewitness wey joinbodi wit odas to rescue pipo bifor officials come tok say im bin dey for one shop wey dey opposite di school wen im hear loud sound.

"Wen I hear di big sound I say wetin dey happun, I kon see say di two-storey building don collapse and students dey inside dey write exam, we run go dia to see wetin dey happun, but we no really know wetin to do in di first place, I no even know how to take call dem [ emergency services], no tools to work wit, wey get to wait bifor goment pipo begin come."

Im say dem rescue some pipo wit dia small small tools and di pipo wey dem rescue dey alive but dia small small tools no dey enuf.

Im add say pipo still dey trapped under di rubbles but im dey hope say evritin go dey okay.

'Di building sink' - Eyewitness

Jos school collapse: Saint Academy closed down by government, three days mourning declared afta building collapse kill 22 pipo - BBC News Pidgin (3)

Anoda eye witness wey identify imsef as MC Iwitness tell BBC Pidgin say na sink wey di building sink enta ground.

"I dey see posts online about di building collapse na im I run reach here, di main story be say di building no collapse but e sink. Di students wey dey Junior Secondary School [JSS ] 1 and 2 wey dey down floor, dey under di rubble and di ones wey dey upstairs na dem bi di major casualties now," di eyewitness explain.

Im add say from wetin dem don see so far rescue operations still dey go on , Army, Police, Civil Defence, Road Safety and oda agencies dey on ground dey go di rescue operations.

"Individuals sef dey join hand for di rescue operations, one young guy wey be one of di first responders faint at some point sake of di dust. Some students dey trapped under di rubble, four excavators dey on ground we hope say di children go come out alive and well." im conclude.

Some fotos from di school building wey collapse

Jos school collapse: Saint Academy closed down by government, three days mourning declared afta building collapse kill 22 pipo - BBC News Pidgin (4)

Wia dis foto come from, Getty Images

Jos school collapse: Saint Academy closed down by government, three days mourning declared afta building collapse kill 22 pipo - BBC News Pidgin (5)

Jos school collapse: Saint Academy closed down by government, three days mourning declared afta building collapse kill 22 pipo - BBC News Pidgin (6)

Wia dis foto come from, Getty Images

Jos school collapse: Saint Academy closed down by government, three days mourning declared afta building collapse kill 22 pipo - BBC News Pidgin (7)

Wia dis foto come from, BBC

Jos school collapse: Saint Academy closed down by government, three days mourning declared afta building collapse kill 22 pipo - BBC News Pidgin (8)

Jos school collapse: Saint Academy closed down by government, three days mourning declared afta building collapse kill 22 pipo - BBC News Pidgin (9)

Jos school collapse: Saint Academy closed down by government, three days mourning declared afta building collapse kill 22 pipo  - BBC News Pidgin (2024)

References

Top Articles
Tracee Ellis Ross shares the 2 things she prioritizes for better health in her 50s
Tracee Ellis Ross Flashes Her Sculpted Muscles And Flawless Skin In A New Poolside IG Photo Dump
Star Wars Mongol Heleer
Skyward Sinton
#ridwork guides | fountainpenguin
Cooking Chutney | Ask Nigella.com
Amtrust Bank Cd Rates
Body Rubs Austin Texas
Usborne Links
Zitobox 5000 Free Coins 2023
Hay day: Top 6 tips, tricks, and cheats to save cash and grow your farm fast!
Canelo Vs Ryder Directv
Oxford House Peoria Il
Busty Bruce Lee
Gmail Psu
Moparts Com Forum
Saberhealth Time Track
Colorado mayor, police respond to Trump's claims that Venezuelan gang is 'taking over'
Craigslist Panama City Fl
Everything We Know About Gladiator 2
Yakimacraigslist
Wausau Obits Legacy
Yard Goats Score
Milanka Kudel Telegram
Scout Shop Massapequa
Adt Residential Sales Representative Salary
Wbiw Weather Watchers
2013 Ford Fusion Serpentine Belt Diagram
Shreveport City Warrants Lookup
Parkeren Emmen | Reserveren vanaf €9,25 per dag | Q-Park
New Stores Coming To Canton Ohio 2022
Claio Rotisserie Menu
Yayo - RimWorld Wiki
Paradise Point Animal Hospital With Veterinarians On-The-Go
Learn4Good Job Posting
Powerball lottery winning numbers for Saturday, September 7. $112 million jackpot
Greencastle Railcam
Maybe Meant To Be Chapter 43
Babylon 2022 Showtimes Near Cinemark Downey And Xd
Jewish Federation Of Greater Rochester
450 Miles Away From Me
Finland’s Satanic Warmaster’s Werwolf Discusses His Projects
Paperless Employee/Kiewit Pay Statements
Yale College Confidential 2027
Europa Universalis 4: Army Composition Guide
Sky Dental Cartersville
Wpne Tv Schedule
Strange World Showtimes Near Marcus La Crosse Cinema
2000 Ford F-150 for sale - Scottsdale, AZ - craigslist
antelope valley for sale "lancaster ca" - craigslist
Craiglist.nj
Peugeot-dealer Hedin Automotive: alles onder één dak | Hedin
Latest Posts
Article information

Author: Sen. Emmett Berge

Last Updated:

Views: 6545

Rating: 5 / 5 (60 voted)

Reviews: 83% of readers found this page helpful

Author information

Name: Sen. Emmett Berge

Birthday: 1993-06-17

Address: 787 Elvis Divide, Port Brice, OH 24507-6802

Phone: +9779049645255

Job: Senior Healthcare Specialist

Hobby: Cycling, Model building, Kitesurfing, Origami, Lapidary, Dance, Basketball

Introduction: My name is Sen. Emmett Berge, I am a funny, vast, charming, courageous, enthusiastic, jolly, famous person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.